Wetin Nigeria military tok about alleged ‘coup attempt’ against Tinubu

Defence Headquarters
Defence Headquarters

One report wey allege say di cancellation of activities to mark Nigeria 65th Independence Anniversary na sake of attempted coup against President Ahmed Tinubu na lie, di Defence Headquarters tok.

Nigeria dey usually mark her independence on 1 October, but e no happun for 2025 becos di president cancel di parade. But on dat day President Tinubu address Nigerians.

Howeva, tori bin come out say dem bin dismiss 16 military officers, ranging from di rank of Captain to Brigadier General.

Di tori tok say dem carry di dismissed officers go di custody of di Defence Intelligence Agency sake of alleged secret meetings to plan a coup against di govment.

Director of Defence Information, Brigadier General Tukur Gusau, for statement wey e sign on Saturday for Abuja, say to tori about di Nigerian Armed Forces dey “entirely false, malicious, and intended to cause unnecessary tension and distrust among di pipo.”

Di statement clarify say di decision to cancel di 65th Independence Anniversary parade na to allow President Bola Tinubu attend one “strategic bilateral meeting outside di kontri, and to allow di Armed Forces of Nigeria (AFN) to sustain dia success for dia ongoing fight against terrorism, insurgency, and banditry.”

On October 1, reports bin break for one local newspaper di tori be say di alleged coup plot bin wan happun on independence day and dem arrest some officers becos of di coup attempt.

Di report tok say dem cancel di Independence Day parade becos of di coup attempt although di military statement don denial di rumour inside dia statement.

Brigadier General Tukur Gusau for di statement tok say dem don start to investigate di sixteen officers and di process go dey within di military internal discipline and professionalism and di panel go make di findings public.

Di DHQ call on all peace-loving citizen to kontinu to support security agencies, as di federal govment, di legislature, and di judiciary dey work closely for di safety, development, and well-being of di nation. “Democracy na forever.”

“Furthermore, di DHQ wish to reassure Nigerians say di ongoing investigation involving di sixteen officers na routine internal process aim at ensuring discipline and professionalism dey maintained within di ranks.

Dem don conduct di investigative panel, and dia findings go dey public,” di statement tok.

“Di DHQ urge members of di public to disregard di falsehood wey di purveyors of misinformation and enemies of our nation dey circulate. Di Armed Forces of Nigeria remain firmly loyal to di Constitution and di Federal government under di leadership of di Commander-in-Chief of di Armed Forces, President Bola Ahmed Tinubu, GCFR.”

Source BBC NEWS PIDGIN

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *